Tuesday, May 24, 2016

DEM DON CATCH FEMALE KIDNAPPER WEY BUST JAIL

The suspect,  wey her name be  Adebisi Babatunde wey dem say na oga for kidnapping , na hin The Ogun State Police Command don recapture after dem tok say she bust jail for Oyo prison. The Commissioner of Police, Abdulmajid Ali, showface the, 33- year-old Adebisi Babatunde before newsmen for the office of the State Special Anti-Robbery Squad (SARS). The suspect wey be member of one notorious kidnapping group wey kidnap one businessman for Abeokuta one year ago.Dem colet N10million ransom from the  man family. Adebisi plus the native doctor wey give dem charm nahin dem don capture by detectives for Ogun still con jail am while other members of the group pio pio pio with wetin them loot. the suspect yan say she get husband plus three children, but her boo kpain for one car accident..

No comments: