Miss Simplicity - Papii Jameh share him nd him wife Kaffy picture for him IG page nd for d picture d guy praise him wife well well o...He tok sey if dem dey call woman wey get correct ogbonge character, na him wife be dat o base on sey d wife na d only woman for dis world wey understand ham nd wey love ham even tho him dey tok nd do sum kind tins wey no gud sumtimes o. Papii tok sey him
word go fail ham o if him continue to dey tok o bt him thank God for d wife wey Him give ham o nd d two children wey d wife born dey make him belle dey sweet o base on sey dem sef dey grow to dey loving like their mama. He come still tok sey him love kaffy die o nd him dey appreciate everyday wey kaffy take dey bear him name... Now dat na wetin I call love, respect nd relationship... Shoutout to those men wey dey appreciate d women wey Baba God give dem....Shoutout too to those women wey dey hold their family togeda even tho e no easy.... We for TPN sef join ur husband to appreciate u ma'am Kaffy...
No comments:
Post a Comment