Miss Simplicity - Beyonce album wey she call "Lemonade" naim don win No. 1 for Billboard 200 o nd dis one go make ham d sixth time wey her album go win no. 1 for Billboard 200 o.
Nielsen Music dey confirm ham sey d album sell wella o nd na her album naim Billboard 200 chart rank as d most popular album of d week for U.S base on d multi-metric consumption wey traditional album sales (TAS),
track equivalent albums (TEA) nd streaming equivalent albums dey include O. As tori tok ham, na tomorrow wey be May 3 naim dem go post d new May 14-dated chart wey Lemonade be No. 1 put for their website...
Congratulation to u ma'am from we wey dey TPN....u too gbaski
No comments:
Post a Comment