Monday, October 26, 2015

EEYAH...PRESIDO FOR DEM OLOSHO FOR NAIJA, JESSICA ELVIS DON KPAIN

No mata who we be for dis life, one day one day we go cross the Jordan. Na so e be for Jessica Elvis wey be presido for National Association for Nigerian Prostitutes wey kpain on Sunday for one hospital wey dey Benin wey dem no gree tell us hin name. According to statement wey dem throway by dem Secretart General Tamar Tion na him dem take polongo say na one kain heart wahala na him kpain Madam Presido and dem sad well well. Dem say Jessica get 15 year old girl wey she leave for life. We pray make God do....do wetin sef? Make God help the pikin make she no be like her mama. All of una wey remain wey dtill dey do olosho, make una reason am again o.

No comments: