Friday, May 27, 2016

MAKE UNA NO TAKE RUSHING MARK BUHARI RESULT FOR ONE YEAR FOR OFFICE - GBAJABIAMILA

House of Reps don yarn Naija pipu on Thursday say make dem calm down as dem dey mark President Muhammadu Buhari result for one year wey he don do for office. The House say dem Oga Speaker, Mr. Yakubu Dogara, still dey report give pipu, and if you wan mark dem make you remember say things don spoil gan before dem enter power in May 29, 2015. The Leader for the House, Mr. Femi Gbajabiamila, yarn am when he dey sama dem result for 2016 first quarter on top wetin dem do so far for the house, come still advise say make una no take rushing score Buhari government O. He say one year no reach to take do abracadabra change the country, so make we no forget say the government dey hustle to see say dem gbege corruption and dem commot am from we country.

No comments: