Dr. Warri Connect wey everybody sabi as Ogbonge Comedian and still be OAP for Lagelu FM don ready to carry him get go anoda level O. Shebi na 2 categories dem nominate am for last NBMA AWARDS, and one of dem be day the guy dey make brains on top TV. So make e for no lost for TV na him make am dey ginger to say us with one kain kasagboa sitcom wey he call Mad Tenants. And to come make the thing make sense die, he carry some of him PADIS for comedy follow body, comedians like Calibird from Lasgidi, Afouda him partner for Radio, Babah Oroh from Ibadan, Favour Kay, one fine babe like Dat wey dey talk for Radio like small pikin inside Krazy Institute of Comedy plus Odis. When the thing go burst enter TV abi na Internet, Dr. Warri never clear us but e say make we dey wait for am very soon, and say dis one na one of the plenty things wey dey come from him Comicwood Cinema. No shaking we dey wait for una.


No comments:
Post a Comment