Sunday, May 8, 2016

HALLELUYAH! AFTA 9 YEARS SEE WETIN BABA GOD GIVE KENNETH OKONKWO ND HIM WIFE O



Miss Simplicity - Kenneth Okonkwo nd him second wife Ifeoma Okonkwo naim tori dey reach our hand sey dem don born pikin yestaday o afta nine yrs wey dem don marry o.
D new pikin wey bring Joy give d actor nd him wife naim Diamond celebrities tok sey ma'am Ifeoma born for University of Maryland, St. Joseph Medical Centre wey dey for  United States of America o nd d papa dey hapi bt him give Baba God all d glory o.


Dis na d first time wey Ifeoma go born pikin bt for Kenneth na him second pikin b dis o, dat is to sey he bin don get one pikin wey Ogechi wey be Christian Pentecostal Mission International Pastor pikin bin born for ham before dis one.
We for TPN dey sey congratulations to d papa nd mama of d new pikin nd we dey pray sey make Baba God guide nd protect d pikin oooo.

No comments: