Monday, May 9, 2016

(FOTO)CHECK OUT KIM WEST PINSHURES FOR VOGUE MAGAZINE COVER




Miss Simplicity - Kim Kardashian naim dey d June Cover of Vogue Australia Magazine nd na custom-made corsets naim she wear for d cover pinshures.
For d magazine Kim tok abt real life heroes, her idea of misery nd many many ogbonge topic o. She tok sey her favorite heroine na her mama o base on sey d woman don go thru many tins to take care of six children nd she no shake. (see more foto) 

Kim tok sey her favorite food  na Beignets from New Orleans nd powdered sugar doughnuts then her favorite drinks na juice o like strawberry fruity drink wey Ferdi restaurant wey dey Paris dey make o. Last last Kim com still tok sey she dey like man wey get gud sense of Humour o... Dis na d first time wey Kim go do photo shoot since wey she born Saint west nd I no go lie una, she make sense for d clothes wey Christine Centenera wey be Vogue fashion designer make nd d pinshures wey Lachlan Bailey shot clear wella.


No comments: