Nawa O... Make God just dey keep person. Tori wey dey reach we hand now dey say dem don see the dead body of the match commissioner for the NPFL Match wey happen yesterday between Kano pillars and ikorudu United. Tori say na for him hotel room dem see him dead body dis morning. Him name na Mallam Tanko Nuhu and na from Nasarawa state he for come. The chairmo for Nasarawa State Football Association don confirm say Nuhu bin no dey feel fine before. Toor we for TPN say make God keep him family and protect us wey remain

No comments:
Post a Comment