Monday, May 9, 2016

CONFIRMER CONFIRMENTO... COURT OF APPEAL CONFIRM 25 YEARS FOR PRISON WEY HIGH COURT GIVE 3 BOKO BOYS

The Court of Appeal for Lagos on Friday don confirm the judgment wey Federal High Court for Lagos sama 3 pipu wey be Boko Haram,  say make dem go take breeze for 25 years for prison. The Appeal Court, for one judgment wey Justice Y.B Nipper deliver, throway the appeal wey the badt guys Carey come say dem no gree for wetin high court first yarn dem. Justice Ibrahim Buba for Federal High Court for Lagos, on September 30, 2014, na him sama dem through Lagos State Government and the Ministry of Justice wey carry dem come court. The State Government bin carry 4 Pipu come court say dem wan do string things filed charges as dem dey hide against four accused persons for conspiracy to information, dey hold weapon plus other bad things. Out of the 4" pipu, dem punish 3 if dem say make dem go do 25 years each for prison, but the fourth person dem free am make he dey go just like dat. Pipu wey dem send go prison na, Ali Mohammed Modu, Adamu Ali Karumi plus Ibrahim Usman Ali.

No comments: