Na Bello Lukman share the tory for hinfacebook page. E say One female student for the Department of Library Science, Faculty of Education Bayero University Kano Sarah Imoleaya don kpain hersef after she drink insecticide. Sarah, wey come from Edo state dropp suicide note say, "I no go apply for course suspension, my acada na all i get If I no fit get am right nko, wetin i com dey alive for. She don already waka go faculty office go cgeck if smething dey wey dem fit do ontop her mata but she see say water don pass garri. Dis one nko na hin make her comot office go, whia she dropp her bag for step. Na for the place, she write the suicide note con comot from her bag container wey contain Sniper insecticide. Dem rush am go hospital where she kpain."
No comments:
Post a Comment