Monday, May 9, 2016

CHEVRON DON PACK DEM STAFF COMMOT AFTA THE AVENGERS HAYAJ DEM

Sake of the kasala wey burst last week on top Chevron oil platform for Delta state by pipu wey call dem name, The Avengers Niger Delta militants, one of the ogbonge comapnies wey dey produce oil for Naija, Royal Dutch Shell corporation don pack commot 98 of dem beta staff from the place wey dem for dey produce wey be, Eja OML 79 for dis last weekend. Tori yarn us say na three helicopters dem take move dem. We still hear say the place wey dem for commot dem, The Eja OML 79 dey produce 90,000 barrels of oil everyday. I hope Dat one no go affect petrol again for Naija.

No comments: