Miss Simplicity - E be one kind for body wen pipu hear sey d Duchess of Cambridge neva post once for fashion magazine base on sey she be one woman wey pipu knw around d world for her correct styles bt na d true be dat o...so for d first time Daily Mail dey report sey for d 100th anniversary wey British Vogue wan do, d Duchess go dey for d June issue cover nd na dress down style she go use, dat is to sey d Duchess Kate no go use ball gowns or ballrooms o instead she go dress casual nd
na for England Norfolk countryside naim dem
na for England Norfolk countryside naim dem
go take snap d picture. Dem don display two of d picture for d current Vogue 100 dat na d Century of Style exhibition wey dey for National Portrait Gallery wey dey UK bt d Duchess seven picture go still come out for d British Vogue issue for June. Na Vogue Fashion Director, Lucinda Chambers naim style d Duchess... See Smile, See Relaxation nd yes See Natural Location...
No comments:
Post a Comment