Saturday, May 28, 2016

AGATU COMMUNITY DON DEY ASK FOR N100M COMPENSATION

Pipu of  Agatu community wey be part of Tiv nation inside Benue state dey demand N100 million compensation from the Federal government ontop the massacre wey armed herdsmen do for dem community for March wey Over 100 pipu kpain. Presido of Mdzough Tiv Group, Edward Ujegbe, yan dis wan for the investigative hearing wey the House of Representatives committee ontop the killings for Benue State by suspected Fulani herdsmen organised yesterday. Dem tok say dis wan nko nahin go make dem renovate evry evry wey dem don loose.

No comments: