Friday, April 8, 2016

WELDONE.... EFCC DON SEE ANODA MAGOMAGO FOR INSIDE NAMA DOMMOT

EFCC throway statement yesterday, April 7, 2016 say dem don catch 5 staff of Nigerian Airspace Management Agency (NAMA) and dem don carry dem go before Justice Kuewumi Babs for the Federal High Court Lagos say dem do  21 bad things. The accused pipu na Ibrahim Abdulsalam, managing director for the agency; Nnamdi Udoh, former managing director (wey dem never fit catch), Adegorite Olumuyiwa, general manager, procurement; Agbolade Segun, general manager, finance; Clara Aliche, director finance; Joy Ayodele Adegorite, Randville Investment Limited plus Multeng Travels and Tours Limited. EFCC say all of dem gather thief N6, 922,676,815 (Six Billion, Nine Hundred and Twenty Two Million, Six Hundred and Seventy Six Thousand, Eight Hundred and Fifteen Naira ) from NAMA. Gbege shele when the Commission get petition wey accuse some management staff of NAMA say dem hand no clean. When EFCC shine light for the mata,  dem see say na true dem third money when dem dey buy wetin no dey .

No comments: