OMOBOLA - Fuel matter don rise by 200 percent o, upon wetin the Nigerian National and petroleum corporation (NNPC) and Independent marketers talk, the minister of state for petroleum, Dr Ibe Kachikwu talk say dem go supply fuel between yesterday and tomorrow, but the fuel matter con dey worse for some State while pipu dey waka long distances self, and pipu dey plenty for bus stop cos no motor wey go carry them. Pipu wey dey lasgidi talk say from oshodi to mile na #50-#100, BT since fuel matter don enter na #200-300 den dey enter ham, okada rider and vehicles owners don dey do vigil for filling station Bcos of fuel. Governor Ambode talk say he dey feel the pain of the pipu wey dey lasgidi, pipu talk say no work, no food, poverty plenty, fuel matter con join am.
No comments:
Post a Comment