Femi Oorun, wey plenty pipu still Sabi as Femi Solar go dey paint Ibadan white dis Sunday when he go dey launch him tear rubber album wey he call MERCY BEYOND. Femi Solar no be small pikin for juju music and he come still get one kain special anointing for jingle, COS if we count 5 radio stations for Ibadan, na Solar sing like 3 inside. Na for Genesis Suite the mata go for dey rock dis Sunday and no be only Femi go dey Tungba Dat day cos some of him padis for the industry go follow am dey to celebrate. Asiwaju Yinka Aiyefele go dey there too cos he sing for inside the album too, na so other too go be like Alaafin ALUKO, Femo Lancaster plus many others. No dull O, make we hook for Dat side.
No comments:
Post a Comment