Saturday, April 9, 2016

SEE LIFE O... DRAKE SONG WITH WIZKID DON CARRY WIZZY BREAK RECORD

Drake song where he for feature Wizkid don become No. 2 song on top the real-time Billboard + Twitter Trending 140 after dem  release am. History yarn us say Since 1958, The Billboard Hot 100 na him be music industry standard record chart for United States and na hit singles dey dey on top. Come reach now,  no Naija pikin don ever dey on top the list. But r be like say we don break the record. On April 5, 2016, na him Drake wey be Canada pikin release 2 songs , ‘Pop style’ whwrw he for feature Kanye West and Jay Z, and ‘One dance’ where he feature Star BOY, Wizkid and one Kyla. We hear say the two songs wey Drake release, na dem dey No. 1 and No. 2 for the real-time Billboard + Twitter Trending 140 cos na him dem don share pass and na him pipu discuss pass for social media network after dem release dem. Na dis one make say na Wizkid be the first Naija artist wey go climb Billboard’s Twitter Last 24 hours chart. We for TPN say congratulobia to Wizzy. Even if na whistle he whistle for the song.

No comments: