Saturday, April 9, 2016

FULANI MALU PIPU DON STILL DO BABA FALAE ANODA STRONG THING O

Bad guys wey dem suspect say dem be Fulani don kpain one security officer wey dey guard former Secretary to the Government of we Federation (SGF), Chief Olu Falae, for him Ilado farm wey dey Ondo State. Moshood Raji, wey be personal assistant to Chief Falae, yarn Sahara Reporter about the mata, he say the security guard dead body na him dem see for one dam wey dey outside Baba Falae farm 2 days afta the bad thing shele. Mr. Raji say na last week dem carry the guy after some kain gbege with the Fulani malu pipu. And na sharperly dem go report the mata give all security agency for the State say make dem help dem shine light put.

No comments: