Thursday, April 7, 2016

NA WA WA OOO... ANODA SALARY KASALA DON STILL BURST FOR BUKOLA SARAKI HEAD O

OMOBOLA - Person wey EFCC bring to witness on top Senate President Mata, Mr Micheal Wetkas talk say Oga saraki dey receive money every month from Kwara State after he don do Governor two times. The man talk say the Senate President wey leav hin office in may 2011 still dey collect monthly salary and pension from June 2011 till August 31, 2015. The witness con bring all the details wet den they pay him, he talk say in may 2011, dem pay oga saraki #291,134.00 as hin salary, June #572,286.32, August #744,002.22k, September #743,942.22, October #1,165,466.12, he con collect double amount wey he collect in October ( December 27 and 28) 2011. The man talk say he dey collect the same amount every month till August 31, 2015, na then EFCC matter con rise.

No comments: