Hmmmm.... E be like say Peter Okoye no dey play with him solo career O, even as dem don talk sat dem don stop fight. Mr P, wey be name wey he dey answer as solo artist, na him we see for inside pinshure with him Manager, and him dancers, when dem dry commot from Naija go do show for Dubai. But tori say no be say Peter wan scatter everything again, e just be like say dem don pay am for the show before dem settle the quarrel. But some pipu sef like dey scatter things sha, una don dey go pay dem for solo performance when pipu Still dey cry dey beg dem make dem come back together.
No comments:
Post a Comment