Shebi na recently one kain video dey waka say Fayose and the former Secretary of PDP for Ekiti state, Tope ALUKO don settle dem quarrel. But the Oga Aluko don talk say na lie O, say he just got to turn actor and pretend say nothing dey happen so nothing go do him wife. Aluko follow press pipu yarn for Lagos yesterday, April 5th. He say dem dey drag mata inside meeting, na so him wife tell a enter come tell am say press pipu dey outside o. He say na so he dey vex commot, but he see say Governor Fayose dey rush follow am downstairs. He say him wife don already dey fear, dey cry and na so the woman take miss for him side. Aluko say na dem he see say, if he no follow Governor Fayose’s instruction, say make he come face press pipu. Dem fit do him and him family strong thing. He say all wetin he talk before say na OJORO dem do, still stand O, dat na why Fayose nd him guys no deny am, na him dem dey attack, no be wetin he yarn. he say make Naija pipu no vex for mistake wey he do as he go the meeting I will and make we Sabi say Fayose na conform 419.
No comments:
Post a Comment