Wednesday, April 6, 2016

MAKE UNA CALM DOWN.... SEE WHEN KACHIKWU SAY FUEL GO FULL NAIJA

Minister of State for Petroleum Resources, Dr. Ibe Kachikwu, don  say make we calm down,  cos we no go see dis petrol gbege again by end of the week. Dat one come mean say wetin Oga yarn before fit shele An as per say dem don dey share 320 million litres of petrol all over we country by yesterday. Meanwhile, we Federal Government don scatter the presidential task force wey President Goodluck Jonathan government arrange dat time to rearrange our light mata but dem no yarn why dem do am. Kachikwu say government fit increase petrol money by next month sha, if crude oil price still dey increase. The minister wey yarn for Abuja when he go see as e dey go for Petroleum Products Pricing Regulatory Agency (PPPRA), say government never return subsidy O.

No comments: