MISS SIMPLICITY - One news come out on Monday, April 11th tok sey Omotola no dey pay tax at all o so she no get right to dey question government on top mata wey concern tax or anytin wey government dey use tax moni dey do for lagos, dat na afta d actress don do one campaign wey she call " Don't Push me" wey tok sey make Government o give her back all d moni wey she don spend for road, fuel nd light o sake of sey na government suppose dey do all dat one for d pipu wey dem dey rule o. Bt now Omotola don tok sey make anybody no believe wetin dem tok abt her o bcos she dey pay tax steady, she tok sey d news na lie nd she nd d government dey work togeda to find d person from Lagos Internal Revenue Service (LIRS) wey tok sey she no dey pay tax o nd she tell Pulse sey dem go send press release on top dis mata soon...Hmmmm....Comment reserved....
No comments:
Post a Comment