OMOBOLA - The ijaw youth council (IYC) don vex o, they talk say dem know say plans dey ground, say the FG won arrest the former Presido Good luck Jonathan. They yarn with the journalist wen dem dey the burial of former Bayelsa state Governor, Dipreye Alamiyeseigha, The presido of IYC Udengs Eradiri talk say EFCC don carry Jonathan's nephew, Robert Azibola and den no say the FG go soon won mention the former Presido. Eraditi con talk say the Ijaw youth don vow to do everything way no go make EFCC carry Jonathan. He con talk say Jonathan na only presido wey perform wella for naija, he con talk say make Buhari do him government wella make he no dey persecute pipu who don add value.
No comments:
Post a Comment