One Federal High Court for Jos, wey be capital city for Plateau State don pursue Amaju Pinnick and him NFF board as dem polongo say na Chris Giwa be the presido for NFF. The court wey Justice Musa Haruna Kurya siddon on top throway the election wey dem do for Warri where Pinnick for win. And Giwa don talk say na instanta he dey go enter work for the NFF office for Abuja and he go mention who and who go dey him new board. But Sha O, Pinnick wey be former Oga for Delta State Sports Commission (DSSC) say he go file for the court make dem first put the judgement for go slow. And e be like say FIFA fit punish Naija on top the mata O, cos dem don first talk say Giwa election no dey okay bcos most of the pipu wey vote no suppose vote.
No comments:
Post a Comment