Thursday, April 14, 2016

NAWA O... PIPU SEE DEAD BODY OF NEW PIKIN WEY DEM THROWAY FOR MODAKEKE

Hmmm. Make God sha dey save person for dis life, some things no dey gree make person reason well for dis life. Abi how we wan take explain pipu wey born pikin finish go throway am. Tori yarn us say dem see one new baby with all him cord wey follow am come from heaven still dey him body near one river for Modakeke, Osun State, yesterday April 13th. By the time pipu go notice am, the pikin don kpain. May God save us and get MERCY on top the bad pipu wey do dis kain yeye thing.

No comments: