According to tori wey dem write for inside one online magazince CITY
SCOOP NG, dem say no be small mata o, wen we Gomina for Oyo State and
him family go do the oyinbo wedding of one of dem pikin Ajibola for
Berruit, Lebanon. Make we no forget say dem don first do the yoruba own
for Ibadan for Cassa Lucio Events Center, dat one shele on Friday, 22nd
August and dat one sef dem no gree make any media persin enter the
place.
Tori say the pipu wey go there shock wen dem yarn dem for the venue say nobody go fit take any kain pinshure o, and no be say dem just talk am, security pipu stand gidigba to fall the hand of anybody wey wan show strong head. Dem just get one lady who be professional photographer who still be the padi of the bride Ajibola make she snap pinshure. We hear say na Basketmouth go do the Mc and na 3 days dem take do the parry....No be small thing.
No comments:
Post a Comment