Friday, April 1, 2016

NICE ONE...SEE WETIN GBÉNGA ADEYINKA DO AFTER HIM SHOW WEY MAKE PIPU DEY CLAP FOR AM.





Dis kain thing fit be small thing for some pipu mind but for some of us na big deal. Na one wise word dey talk say "Na hand dem dey give repairer,  when bicycle don good". Dat na why pipu go do show,  wey make brains and afta the show,  dem no dey look back. But Gbénga Adeyinka no do like dat, he no just send 


thank message,  he still design graphics take say thank you. Haba.... I no sure say I don see dat kain thing before, and I think we need clap for Bros, he try wella. Na when I look am well, I see say he still dey take style polongo, the Oshogbo own wey go shele for June 12. I think dis na beta thing wey other pipu too suppose dey do. Boss you do well.

No comments: