Social media persona wey still be politician pikin, Kemi Olunloyo, 51, dey always like chuke nose for celebrity mata wey no concern am, she don do Dat Akin thing to pipu like Olamide, Jumoke Orisaguna plus including her father. But the person mata wey she face now na Denrele Edun. She say Denrele Edun na the two he dey do, he no be GAY and she think say Denrele don take style yarn pipu wetin he be, when he talk say na him be the Caitlyn Jenner for Naija. He say no law sha talk am for Naija make person no change Lane from guy to babe, na only gay and lesbian our law no gree. She say Denrele get him style and she love am for dat.
No comments:
Post a Comment