Monday, April 11, 2016

LEGGO... MONALISA DON READY FOR WHITE WEDDING

MISS SIMPLICITY - Monalisa Chinda nd Victor Tonye Coker wey do their marriage for February dis yr naim we hear sey dem wan do their white wedding for May dis year ooo nd tori tok sey d wedding go make sense o dat is to sey d wedding go hold ground nd many many ogbonge pipu go attend o nd na for Athens for Greece wey be tourism city naim dem wan take do ham..u go fear fairytale wedding naw.. Congratulobia ma'am Monalisa Chinda, we dey hapi for you nd we for TPN dey pray sey make Baba God o dey continue to dey guide una oooo

No comments: