AFOUDA: This one na my personal opinion sha, but the thing pain me gan. Cos e just be me like say person no get self confidence for himself. I no too dey put mind for private life of actors abi actresses, but one babe wey I don dey hear about recently na Mercy Aigbe cos almost all the babe's wey surround me dey believe say she too Sabi dress, she get beta fashion sense and all, and as a blogger I still dey see her story dey fly well say she over Sabi. But e be like say na pipu believe her, she sef no believe herself, abi how you wan explain say few days afta one newspaper no
mention her name join pipu wey Sabi dress, she don go hire Swanky Jerry wey dey dress for other actresses like Tonto Dike, Juliet Ibrahim to dey wear her cloth. I fit dey over react sha but wetin pain me be say she don throway all the ladies wey dey always look up to her say na she be dem fashion role model. Dis one no be only her own hand she fall, she don fall the hand of the full pipu wey dey do yoruba film, she just paint dem like say the best of den even get inferiority complex, dem go do everything possible, even lose dem identity cos dem wan make pipu compare dem to others. I shake my head!
No comments:
Post a Comment