Friday, April 15, 2016

I NO DEY HIDE MY PIKIN FROM HIM MAMA O ...DANIEL ADEMONIKAN



MISS SIMPLICITY - Pipu don dey carry news sey Daniel Ademonikan wey be film director dey keep d pikin wey him ex-wife born from her o bt d director don com tok sey na lie pipu dey tok oooo. Doris Simeon born David for Daniel before them divorce nd d man marry anoda woman... Daniel tok sey him bin no dey tok bcos him no join pipu wey dey carry their family mata put for media o, he tok sey him


 pikin wey just complete 8yrs naim dey for gud terms wit him mama o, sake of sey d boy knw him mama nd Doris dey always visit d boy o. Daniel tok sey him bin no wan tok for dis mata o bt him see sey him need to make those pipu wey dey carry bad news see sey him no be bad man o. Daniel post one picture wey Doris nd David snap for Atlanta wen doris visit dem nd he com tok sey abeg o make bitter pipu, jobless pipu nd sad-u-see pipu no dey carry lie lie news.  Last last he com tok sey abeg make Doris let dem take care of their pikin in peace... Hmmm...see correct man....

No comments: