Na 2 pipu kpain last Tuesday night for Sango area wey dey Ogun State, na Eiye and Aiye dey do dem Parole O. One IGBO man wey dem no Sabi for the area plus one other truck-pusher, wey everybody Sabi as Apa na him dem shoot die. Dem say na Aiye pipu do the hayaj take revenge dem Padi wey Eiye pipu kpain. Wetin shock person for the mata be say the place no far at all to the base of dem Quick Response Squad, where police put Armour tank for. Dem gbege no gree business move for Ogba Fadina cos dem no allow trades make dem enter especially those wey come from Ghana and Benin. Tori yarn us say the badt guys just come open fire for pipu wey dey inside, na when dem commot dem see say APC and the other IGBO man don kpain. Wen press pipu halla police megaphone for Ogun, he says he never hear Dat kain tori O, say he he goblet dem know how far when he hear.

No comments:
Post a Comment