Wednesday, September 16, 2015

OJU OLE RE...SEE THE FACE OF GUY WEY THIEF BIGFEM CAR FOR SHOPRITE WEY DEY RING ROAD

Na wa o, everybody shine your eye o, cos e be like say thief dey for we dommot o. Na him make Mr. Olufemi Adebisi Bakare wey plenty pipu sabi as BIGFEM climb on top facebook go polongo the pinshure on the guy wey he say thief him car for shoprite wey dey Palms Mall for Ringroad on Monday 14th September. The car na Honda CRV 2001 wey be black and e get plate number LND 43 DP. Bros no yarn us sha how e take get the pinshure. Pipu shine your eyes o!

No comments: