Wednesday, September 16, 2015

KERE O!!! NOMINATION FOR SONG OF THE YEAR FOR IBADAN DON START O

The oga patapata for Gbedu Republic, Pussiness Ade Nelson don polongo o, say dem don open door make una dey nominate song wey totori you and wey shake Ibadan pass from July last year come reach August dis year. The award na to tuale we beta pikin wey do well for we music industry for Ibadan. The parry gangan wed dem call The Industry Party go shele for November and dis go be the first time wey dem go do wetin dem call "The Industry Award". To sabi every every especially how u go fit take nominate, go on top dem website; www.realpussiness.com

No comments: