Friday, April 15, 2016

CHAI...NA GOD SAVE EMMANUEL AMOS ANDERSON OOO

MISS SIMPLICITY - Emmanuel wey join d finalist for Mtn Project Fame Season 9 naim nearly die for one accident o bt Baba God use Him mercy take save d guy o wen anoda motor com hit him own o. D motor spoil no be small for d driver seat area o, even d mirror show sey d tin damage bt nothing do Emmanuel o. For d picture wey him post, he write on top ham sey " Dia Is God o nd na Him save me yesterday night...Congratulobia to u o Emmanuel, we for TPN dey pray sey make Baba God dey save us wen devil carry him wahala com ooo...

No comments: