Nollywood star Nonso Diobi don break leg O, for one kain yeye accident wey shele yesterday, Sunday April 17th. Nonso climb on top him Instagram page go share the news with his loyal pipu come still ask make dem dey pray for am. He still talk for the post say he believe God dey allow some kain thing happen,
so we go fit Sabi those wey be true friends and ones wey be fake. He come polongo say he go appreciate O, if anybody get contact wey fit make am well sharperly and make we dey pray for am. As we no come get contact, we pray make God heal am sharperly.
No comments:
Post a Comment