Saturday, April 9, 2016

(FOTO) PLENTY CRY AS DEM BURY CORPER WEY DEM KPAIN FOR RIVERS ELECTION

Hmmm.... Shebi na serve he commot for house say he wan go serve him Papa land, before dem carry am go Rivers make he go do election where dem for kpain am. Corper, Samuel Okonto, wey dem kpain for election wey dem re-do for Rivers state na him dem don bury yesterday for him village Illah town wey dey Oshimili North Local Government Area for Delta State. Dem give am national honour sha as dem cover him coffin with Naija flag,  but I believe wetin the guy need pass that one. Na make dem catch and punish pipu wey kpain am. Ma him gentle soul rest in peace for Baba God side.

No comments: