CRIS - Sunshine stars staffs don vex finish o say dem go strike if the management board refuse to pay us our 7 months salary. Dem yarn say the former board led by chairman Akin Akinbobola juust dey post them till he comot for the sit, dem come talk o say the new chairman with him board members Prince Mafo dey threaten them say anybody wey talk about salary, na sack letter he dey take play so. Dem self come dey cry out to the government say make dem step in to the matter o ontime or else, sunshine stars no go perform well at all this season Bcos hunger no fit enter belle make another issue enter am o.
Tuesday, April 19, 2016
ALUTA CONTINUA .. STAFF FOR SUNSHINE STARS WAN VEX GO STRIKE
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment