Thursday, February 25, 2016

16 YEAR OLD BABALAWO PIKIN DON KPAIN, WEN HE DEY TRY DO BLOOD MONEY

Na WA O... One16-year-old boy Raimi Fathi don kpain for Abeokuta, Ogun when he dey try do blood money. Tori yarn us say the boy Papa na Babalawo, na him make the boy gather 3 of him padis dem, come go dey follow wetin dem write for inside the book wey him Papa dey use. But as per say the boy never sabi finish, na so the thing go kill am O. Tori yarn is say na Dat kain Valentine time the bad thing shele, the boy bin chop somethings when he dey try form egbeji and na the thing make am sick,  wey he come kpain 2 days after,  him other Padi wey follow am chop the nonsense still dey hospital sha. Dem sha don bury the boy and dem school don chase all the students wey Waka pass for inside the tragedy movie. Make God sha dey save us ni O,  wetin dem wan take money do like dat?

No comments: