Sunday, March 20, 2016

WE BIBLE PASSAGE FOR TODAY FRM D PIDGIN BIBLE OB'S VERSION.




OGINI BERNARD - LUKE 22:1-6
d feast of passover don dey reach, where d chief priest n d scribes dem dey find way to catch jesus.  Satan con enter judas wey hin papa name na iscariot who be one of d twelve disciples. 

Judas begin misbehave as e forward March go meet d chief priest n d officers dem, as e yarn dem say hin fit catch jesus bring am com. The chief priest n d officers dem happy n dance as dem con promise am say dem go give am money. Na so judas begin arrange to betray jesus.


PASSOVER - 7-13
As time dey reach to chao d Passover; jesus send Peter n John say 'make una go arrange where we go 4 chao d passover, dem ask jesus; oga where u go wan use make we arrange. Jesus answer dem; make una enter town, una go see one man wey dey carry basin of water follow am go d house wey hin go enter, make una tell d landlord say oga and hin disciples dem go use hin place chao dinner where make hin use? D man go show u one big upstair wey make sense wella d room big with confirm chairs n table; make una arrange d place. Peter n John pio go d place as dem do everything wey jesus yarn

D SUPPER-    14-23
D time con reach, jesus n hin disciples show 4 d place as jesus sidown begin yarn; I don dey look forward 2 dis day wey me n all of una go chao together b4 I suffer becos I no go chao until all dis package don register 4 God Kingdom.  As hin holo d cup e give thanks; con say make una take, share am becos as frm now my mouth no go touch wine until Kingdom of God show. As e continue he collect bread, look up begin thank God, he break am con give hin disciples dem 'na my body be dis make una do am take dey remember me as hin pour wine 4 cup do d same thin say; dis cup na d new covenant, na my blood wey I wan pour Comot 4 una as jesus continue he con yarn say; pesin dey here 4 dis table wey go betray me. D disciples begin ask der sef: oga who fit be dat one sef?

No comments: