One Federal High Court wey dey siddon for Yengoa, Bayelsa state, don sama, Yunusa Dairy wey kidnap Ese Oruru bail for N3 million. Yunusa na him dey before court sake of say he kidnap 14 year old Ese from Bayless, come carry her go Kano state where he take by force marry her come even change am to Muslim.
When the mata come court yesterday wey be March 21st, the judge wey siddon on top the mata, Justice H.A Nganjiwa, say wetin the guy go do before dem free a. na to go find 2 sureties wey dey stay for the side where the court dey and for get power, one of dem gats to be be civil servant wey him level no low pass level 12 and the second one musto be person wey get title... but before he get all dis things dem say make he go dey collect breeze for prison.
No comments:
Post a Comment