MISS SIMPLICITY - Peter don answer him broda beg for instagram. He tok sey him wan clear pipu sey him nd him brodas no fight o, he tok sey psquare still dey only sey na different managers dem get now.
He com still tell him Broda sey "abeg no go dey post tins wey pipu go take dey look me like sey I be Judas, sebi u bin don go solo wen u do music wit Tiwa Savage nd ur other musicians bt I no vex, I still follow u sing as psquare" he tok sey him do mistake put family mata for media wen him post abt Jude for instagram nd he beg pipu make dem no vex, he com still thank him fans nd pipu wey put mouth for d tins wey bin dey happen. Finally finally peter com beg baba God sey make Him bless Paul nd Jude well well bcos he love them wella.
Hmmmm we hapi sey una no fight...make Baba God dey help una two ooooo...
No comments:
Post a Comment