MISS SIMPLICITY - D actress wey bin dey fight for her life for one hospital for USA don post for media sey she don well o nd she tok sey she dey thank her fans nd her ex-husband o for d love, prayer, visit nd care wey dem show her wen she sick o.
She tok sey na Baba God go help her reward d pipu wey give her love nd care wen she sick. She still tok sey now o, she don dey do the normal tins wey she bin dey do before she sick nd she thank God for him protection nd mercy. She say thank you to her fans, friends nd colleagues wey no abandon her wen she bin sick....Congratulobia ma'am Onuoha, we for TPN pray sey make God no let u see dis kind sickness again o.
No comments:
Post a Comment