Toor....dis story be as e get O. Tori yarn us say after South African gay musician Koyo Bala suffer Anal cancer for 3 years, he don finally kpain at the age of 36 around 9am on Monday for Groote Schuur Hospital wey dey Cape Town. The guy na part of pop gay club wey dem name na 30pm, other members na Jeff Moyo plus Amstel Maboa. Dem popular well for how dem dey fight for gay rights for entertainment industry. Na for 2011‚ the guy polongo say he be HIV-positive, and na for 2014 dem talk say he get anal cancer, that one mean say he get cancer for yansh. Last time wey he send tweet about him sickness, he say he pray 2 God everyday 2 help am pass the cancer come put plenty hashtag wey show say the guy dey suffer no be small. Dem Padi wey follow dem dey same band, Moyo kpain in 2010 from HIV/Aids-related mata. Now na only Maboa remain for dem group.
No comments:
Post a Comment