Tuesday, March 22, 2016

TIMI DAKOLO TAKE BRAIN YAB HIM FAN WEY YARN OPATA

Timi Dankolo wey just get him masters for songwriting for one college for USA nd wey dem just annouce him, 2face Idibia, Waje and Patoranking as d coaches for d maiden edition of d Airtel sponsored show, d voice of Nigeria don para, don tear for one of him fans wey tok anyhow on top one advert wey him do for sterling bank. D fans tok sey d advert dey vex ham die.. Na so Timi wey bin don tok ham sey him no go let any fans wash mouth for him body dis yr para enta him instagram reply d fans sey " Stay dia dey vex while I dey make my moni" he com still tok ham sey " Hate o, na waste of emotion......See washing, dey vex while him dey make him moni...carry go Timi, ur head dey dia...

No comments: