Pastor Chinko, one of we comedians for Ibadan wey dey make brain don ready to gather him fans make dem laff wella dis Sunday, na for Church he wan make am happen on Sunday 27th march 2016 for LFC church wey dey OPERE junction beside TOPONE garden ib.
Tori yarn us say red carpet go shele for 3pm while the show gangan go be and for una to Sabi say no be small thing, Chinko don polongo say na free for first 200 pipu wey show. Plenty awoof wey go plenty for there na free Internet By Smile Telecom, Shoes by YNORTH, Dress By Novandi couture, Phones by Solat Telecom,photos by Exclusive CareTv, Kazy photography, sdc pictures,Groovy grapix production, Chapman by 3rinity, Cake by Holadd and like dat like dat ...Pipu wey go do comedy na Bayo Faleke for fresh fm, Lateef Adedimeji , Monsuru , MC Damola, SACO,MC Solid ,MC Obama ,Woli Agba Alfa Sule, Peteru ,MC Shete ,Rapindady , DR Frick , Dance go be from TJ Dance ,THE xpandables ,Music by Fantastics drum ,BABATUNMISE, OLAJIRE twins plus plenty others. So make una no dull am O. Don't miss it 4 any reason...
No comments:
Post a Comment