Tuesday, March 22, 2016

GHEN GHEN...SEE AS MERCY JOHNSON TAKE SHOW BACK FOR FILM LOCATION

As e dey hot, Mercy Johnson wey be disappear go from our screen sake of sey she born nd she go London go flenjo wit her family, wey com back sum weeks ago, don start to dey cook one film for us wey dem title "Share My World! Nd tori tok ham sey d film go make sense die base on sey na Mercy dey play d lead role for d film nd d pipu wey join d film na pipu wey make sense too, pipu like Amanda Ebeye, Junior Pope Odonwodo, Eniolorun Susan, Uche Ebereagu nd sum others wey dey gbono feli feli. Na Asaba dem for dey shoot d film nd na Cheta be Mercy name for d film. Ehennnn as dem tok ham, make we dey wait bcos I sure sey many pipu like me go don miss her face for films like kilode....

No comments: