Na today court resume dem gbege with we Senate Presido, Bukola Saraki on top say he lie 0 him property. Tori yarn us say na around 10 past 10 DOS morning na him Justice Dan lady Umar enter the courtroom, but Lawyer wey lead Saraki's plenty lawyers Kanu Agabi polongo to the court say na 66 lawyers, six SAN dey for court wey wan fight for Saraki.
Saraki we hear say enter the courtroom of the CCT exactly 9.55 with plenty of him supporters wey just dey happy anyhow.
Na pure white guinea brocade he wear and he get plenty senators for him back as usual, dem plenty so try dem occupy 5 benches wey dem bin keep wait for dem. Dem say before Saraki go SIDDON, he go hail Jim Oga lawyers wey Kanu Agabi (SAN) dey lead. Dem say after he shake Agabi, he come still stretch hand Jacobs, wey be the Oga after against am.... Na so all him supporters Halla.... Nooo, say make he no try am. Na so him too sharperly commot him hand go siddon where dem keepfor am.
No comments:
Post a Comment